Thursday 16 July 2015

Troublesome Woman (Hotel Staff) Beaten by Military Men in Regina Awka

Nemesis don finally catch up with one troublesome woman wey do work for one hotel wey dey Awka.


Even though I would have love to post exactly what happened in English, Guy I prefer to gist you in Pigin Call it Broken English if you like.

WETIN HAPPEN?


Oga, the whole matter still be like film to me o. this one no be “dem say dem say” because I dey there wen tori begin wowo ….but I go start from the very begin.

The woman in question na correct gbese woman, after the matter don shele finish, I come dey hear say the management of the hotel don sack plenty people comot from the hotel because of this same woman. Imagine person wey dey work as auditor come begin dey threaten workers for the hotel like say na she get the hotel. The worst be say, she no dey ever dey wrong.

Today, as usual, I go this very hotel to go chill out with some of my guys and to do the thing I do (writing). E no tay this woman just appear from nowhere come begin dey harass me. She say see as I occupy one full table.
“Remove all this things joor… in fact anytime wen you come here you go dey pay for light. Nonsense! No be say you dey buy drink or anything, you go just come here occupy everywhere”

my guy I no know say I don robust like that o…

E no tay she just suddenly get up from where she sit down, carry her two left leg waka only her o, by herself, with herself, through herself waka go meet two military men wey dey jolly with their babe base on say dem just return from sambisa forest where dem don dey for like 3 years.

The woman go dey bully them say why dem go buy food from outside enter the hotel. Na im one of the soja come ask am say whether na so dem take dey talk to their customer? Gan gan! O boi the woman just burst o… “My friend, what do you mean by that?” before I say ‘gbagan’ the woman do woz one the military guy o shuuuu….Na im the other one stand up come like “Madam wetin dey worry you?” Gbwua! She slap the other one, push am, come begin dey shout o… “Na bcos you be wear soja cloth?” O boi, wetin follow next guy my mouth no fit yan o….just watch am yourself.




 

https://youtu.be/6SaGGsg6FvM

DOWNLOAD VIDEO






 

 

 

After dem don arrange dis woman code finish, the sojas come dey the hotel premises dey buga. Eno reach 20min, omor SARS don land for the cabal…According to them, dem get informate say the guys (sojas) dem na armed robbers and even book haram. Them harass the two soja guys even put hand cuff for one hand, before dem begin ask for identification.

When dem come later find out say d guys dem na real military men, them come begin dey beg…Na so I see am o… no be small thing o.

>>>>>>Abeg drop you own comment<<<<<<


!function(d,s,id){var js,fjs=d.getElementsByTagName(s)[0],p=/^http:/.test(d.location)?'http':'https';if(!d.getElementById(id)){js=d.createElement(s);js.id=id;js.src=p+'://platform.twitter.com/widgets.js';fjs.parentNode.insertBefore(js,fjs);}}(document, 'script', 'twitter-wjs');

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...